Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Tinubu orders deduction of salaries of civil servants?
by
Cossyblack
on 12/03/2025, 09:05:24 UTC
The President Bola Tinubu-led Nigerian government has ordered continuous salary deductions from federal workers to recover "excess payments" made in December 2024, blaming the situation on a system error. 

The Office of the Accountant General of the Federation (OAGF) confirmed in a Friday statement, signed by its Director of Press and Public Relations, Bawa Mokwa, that deductions are ongoing and will continue until the overpaid sums are fully recovered.

This move has come as a shock to many civil servants because when the money was paid last December everyone thought it was exmass bonus which is usually what is done during festive periods, what do you think that the situation?

https://saharareporters.com/2025/03/08/tinubu-government-orders-salary-deductions-nigerian-workers-claims-december-was-overpaid

Why Dey even make that kind mistake right from beginning, me I never hear am before say government Dey pay salary in excess, me I just Dey reason say dem do that thing intentionally, maybe money Dey wey Dey wan push out, na why dem decide to use that strategy, no Dey surprise say no be all accounts dem go deduct money from their accounts, d once wey dem no commot anything for their account, na their own accounts be that.

Anything wey dis government do Dey always Dey suspicious to be, because they fit make use of any strategy to steal money, so even if something’s wey happen na real, me go Dey feel say Dey just wan scam us.

No govt dey above errors even private companies dey make erroneous payments and at the end of the day Dem go still notify the staff for deduction talk more of a Govt wey dey pay thousands of workers,the point I dey try to make be say No Govt is above mistakes as errors is inevitable.  This is only a one month deduction, Nigeria workers go survive am, they don see worst so I believe Dem go survive this one.

we know say this Govt dey corrupt right from the very beginning.Even though no govt dey above mistakes Nigeria govt own look suspicious because of dere corruption nature. The strategy wey dis Govt fit use be this,Dem fit creates  thousands of ghosts workers accounts,Dem go come over credits those  accounts with the excuse say na mistakes and at the end of the day Dem go retrieve the money back,pocket am for dere accounts Den deletes the records.