Trading signal no too bad like that if you dey fit get the update drop on time and you the trader come gat Sabi use know how to apply the signal too. The problem wey plenty people the get about trading signal nah say some of this signals fit reach you late when the right time to apply am on the particular coin you dey trade with don pass or you fit even the go use signal of 1hr trading timeframe for 4hrs timeframe which fit cos you losses too.
And funny enough sef, people Sabi use large sum in trading when it be say nah one alleged professional na send them this signal onto say them no wan fail from making massive form the opportunity. Na this one be the FOMO side shaaa
I fear trading signal pass anything. The first time i say make i do small trading na so i blow my account and that time na my last card way i for use pay my school fee i con use am trading and na one of my course mate put me for that group. Bro the first advice i go give person sef for anything trading an say make them no rely on trading and signals and trading bot. I no sabi trade o but i done put my hands for plenty things wey get to do with trading and e no work out well so i dont leave am.
Your story dey very pathetic and e good as you gat learn your lesson then hard way if not, if we dey talk about how hard trading be, just like some persons you for fit follow the argue say trading no hard. Just like somebody ask me sometime say abi trading no be to just know about FA and TA and I just smile I no gree follow am argue.
To the use money meant for another project for trading na very risky decision than even the decision of being a trader because it's like the person no even get financial management/boundary on what money way meant for trading and that which is not. People don lose the last money them get because of wrong advise from all these online channel traders and it's very bad of them.