For about four months now, peace don return for Birnin Gwari local goment area of Kaduna state, northern Nigeria, afta one peace agreement di state goment reach wit di bandits wey bin dey terrorize di area. Di bandits bin agree to drop dia arms and stop dia reign of terror for in and around di state.
For dis matter, some security experts dey see am as beta development if dem put correct measures in place, e fit bring lasting peace for di northern region wey don dey battle insecurity for ova ten years.
Everybody they wish make peace they everywhere but this North matter serious ooh and I they feel say them no fit stop am ooh because na only when bandits they terrorize because of hardship the government go make promise for settlement and them close the case but this one's way they always happen for Meduguri pass waiting them go fit negotiate ooh because the terrorist them on there own get there own demand and waiting them want from the country.
I been hear say them want the country to have only there religion and you and I no say for this country nobody go fit tell you say you most belong to one religion way them detate for you, so since them no fit get waiting them want them fit they worry or no gree for peace so na the problem way just they.