For about four months now, peace don return for Birnin Gwari local goment area of Kaduna state, northern Nigeria, afta one peace agreement di state goment reach wit di bandits wey bin dey terrorize di area. Di bandits bin agree to drop dia arms and stop dia reign of terror for in and around di state.
For dis matter, some security experts dey see am as beta development if dem put correct measures in place, e fit bring lasting peace for di northern region wey don dey battle insecurity for ova ten years.
Dr Yahuza wey be security expert and di managing director for Eagle Integrated Security and Logistics Company for Abuja, Nigeria capital believe say any measure wey dem fit take to avoid bloodshed suppose dey welcome since e fit bring peace, and di money wey dem dey use fight insurgents fit be use build infrastructure.
E tok say di bandits na Nigerians, which mean say dem fit go live dia lives for community.
"Dis bandits na Nigerians too, and some of dem fit get talent wey go fit benefit di country if negotiation happun between both sides. Because e go bring peace for di community."
"Di peace wey dey Birnin Gwari right now na proof say di peace tok fit produce beta result."
source how you take see am.
Na really good thing say peace don return to that part of Kaduna in question and na very good development, but one question wey I for like to ask our leaders be say; who empower these bandit with arms wey them they take terrorise the area, no be still our government?
If to say them dy interested to do the right thing from the very beginning them for no enter this tight Conner wey them enter so, wey come warrant them to be paying this criminals amnesty, now those law abiding citizen of the state nai come become mumu na, because by the look of things, our government dy exalt criminals and put them on salaries without doing anything, all in the name of armnesty, and punish the quiet and law abiding citizen of the state.
Though na good move just for peace, but na move wey make the law abiding citizen look stupid, because even some of the civil servants never see their salaries for months, while the government no dy use the salaries of this criminals play, it's really not fair.