Di rate way many people especially di younger ones de take rush enter crypto trading based on wetin dem de hear de very alarming. Unto say dem de find online jobs or side hustles, dem go get misleading information say crypto trading na di place to de make plenty money everyday. When dem rush enter and lose all dem funds, na dat time dem eyes go clear say no be get rich quick scheme and say trading no be for everybody.
I no know if Una do observe all these people way the come radio stations the talk about trading seminars and how people wey dey interested make them text a code to their phone number then them go reserve a seat for them. As in, this people go the talk for radio about how easy trading is, and how you don't have to fear or stress much to be a successful trader in no time.
Seriously, whenever I tune to these stations and hear this people talk I feel sad for the innocent people wey go believe their talks. But go later on realize am when them go done lose enough money wey dem no expect. Abeg make we dey try preach to people about the risks involved in trading more than we talk about the profits we make.
The truth of the matter is that no be everything them dy advice person on, e dy very important make the person experience am, so that If as you are a trader today and them they see you dy make am from it, them no go just wake up one day and take you for granted.
Most of this young lads no know say behind every successful man out their in a field he endeavors in, their are so many sacrifice and sleepless night he put in just to get to the level he or she is, but truly, trading no dy easy, but once you masters the craft, you be big short honestly.
Then concerning those people wey you dy talk for radio station, see to be honest with you, some of them dy good in the business and they are making a living from it, where the major problem they is you that want to learn from them, the question is; you fit get to such level?
Because I believe say even for school wey lecturer dy teach, no be all students dy Sabi or even get close to the level of the lecturer, because in trading, you must show working, nothing like copy copy, so you must put in your own personal work and sacrifices just to perfect the craft,so that one nai make trading hard.