Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Negotiations for peace deal wit bandits go fit solve Nigeria insecurity palava?
by
Mpamaegbu
on 19/03/2025, 22:14:29 UTC
For dis matter, some security experts dey see am as beta development if dem put correct measures in place, e fit bring lasting peace for di northern region wey don dey battle insecurity for ova ten years.
For me, bandits na criminals dem be. Dem go soon return to their criminality wit time. There's a reason wey make govment of betta kontries nor dey negotiate wit bandits. And na bc dem see dem as unrepentant criminals.

If we look at d issue wella we go still find dat thin line wey dey between banditry and freedom fighting. So, make we nor mistake am wen freedom fighters drop arms and resume normal lives wit wen bandits try to do d same.

Make we just see dis peace wey dey now as ceasefire moment, nor be lasting peace.