Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The future of e-Sim in Nigeria
by
Cryptohygenic
on 25/03/2025, 09:41:19 UTC
This one na medicine after death because our Nigeria government dey always get advanced dreams like this but at the end Dem no dey do am.
How many of us also remembered the introduction of E-Naira? How far of am now? Nothing good still come out of it because the project no get potential.


Since data cost done increase so much like this GLO say dem go give 5GB data bonus to all customers wey go activate e-SIM and with a data plan of at least N1,500 every month.


Leave glo network abeg, the normal SIM way dem don invent na em be the worse network provider we get for the country.
You know how people way dey use the  glo network  dey lost their money on data subscription may dey expire bcos of poor network?
So na 5G data dem want take buy people mind?
Make dem focus on building strong network no be this e-sim be people need.

Your right because Glo network is one of the worst network that you can ever use especially when it comes to browsing it can be frustrating sometimes because you can actually have a data but you can't really do anything with your data due to bad network, accessing the Internet with glo is a problem and they really need to improve on their services because more people are getting leaving their net.


I will still blame government in this issue of failure of service providers to live up to their responsibilities because government has not taken a stand on it they like the way that the citizens are complaining this may be due to the fact that key government officials may have links with some of these service providers


The current problem of Nigerians with the network providers no be advancement from Sim card to E-sim, na stable and reliable network provisions way be say users go fit make calls and access the internet freely with no network breaches.
If Dem not fit fix the current challenges com dey see am say the necessity to upgrade na by E-sim, e go still bring dem to failure because upgrading na to solve immediate issues make e no dey occur again maybe if further issues go rise make e be future ones no be to leave wetin dey trouble users say na how to make big name of digital upgrade be the main tin. Abi Dem want tell us say sim card get insufficient reliable service provision?
Make dem shift abeg.