Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: History of najia local board (how e Tay start)
by
POPOLUV
on 26/03/2025, 09:15:26 UTC
My People, Una weldone o. If una see the joy wey I dey get like dis so, una no go believe as I be like person wey don chop overfeeding. Well as Una see the title, history of nija local board. I just dey reason am say as many new naija board members dey enter forum, Dem suppose still know small history of how our oga Dem take fight their way till we finally got our own local board last year. Yes last year so we are actually just 1 year old. Hurray nija board members although I wasn't here at that time, but I'm grateful to be a member of this wonderful forum. And so far nija board has shown many impressive statistics in d past few months and we are happy to be amongst d most active local boards of d forum. Thanks to many of our new members and oga Dem wey dey do all their best to make sure say the local board dey clean and much more interesting than when it was just a single thread. Well enough of the talking, follow me through this short history of naija board and be amazed, just as I dey when I dey compildis thread. Like dis now, we don show say really, we Nigerians no dey carry last.



In d early days of the forum, when Bitcointalk nova dey popular as e dey now for we country, our old oga Dem find Dem way to dis ogbonge forum. And having being an African, a Nigerian, all of dey do very well here for BitcoinTalk. Dem really represent us d Africans very well, con create better reputations for inside dis forum. So far, some early men Come see say e go make more sense, if Nigeria get Dem own local board.

So on d 08 February, 2019, our oga @ Mpamaegbu come create d first ever nija board request thread wey e title Nigeria Local Board: Theymos take Note. Dis request was shocking and other men for naji wey see say d idea make sense come support d thread well. Dem hold ground with our oyibo men Dem. If you read through d thread you go see how many people Dem use mouth take finish our people Dem but Dem no gree. Sha Dem no grant d request dat time,but other many top oga con suggest say since na d first request, e go better make we first create something like a local language thread first. Dis idea na to calculate d amount of active members wey dey we country before Dem go fit reason to give us we Localboard.

With so many suggestions, on d 17 of march, 2019 oga CryptopreneurBrainboss come create de African bitcointalk community hangout thread. Dis name wey he give am, na to give way for other countries Dem wey dey Africa to tay take part for d discussion thread.

Images of old African community thread:




To bring awareness about d Africa Bitcointalk community hangout thread, @CryptopreneurBrainboss come reason am say e go make sense to start a signature campaign. Dis campaign na to take show other African people Dem wey no dey aware of d thread to no about am and join d discussion. Dis was how d Africa Bitcointalk community hangout signature campaign was created.D campaign dey for both paid and free volunteer signature dem. other members of d forum like and appreciate d idea wey brainboss boss bring and some con help create signatures and avatar even personnal text for dis campaign to take start.

Some of the early avatar : created by cabalism13




D signatures for d campaign: created by @ Heisenberg_Hunter

 
Quote
Member rank
▬▬▬▬▬      BITCOINS - AFRICA      ▬▬▬▬▬
There's a thread dedicated for Africans to hangout and discuss general issue and issue relating to blockchain development in Africa.
▬▬ Join Africa Bitcointalk signature campaign ▬▬


Full member
▬▬▬▬▬      BITCOINS - AFRICA     ▬▬▬▬▬
There's a thread dedicated for Africans to hangout and discuss general issue and issue relating to blockchain development in Africa.
▬▬ Join Africa Bitcointalk signature campaign ▬▬


Senior members and above

░░░░░░░▄▄▄▄▄▄
░░░░▄██████████▄
░░░██████████████
░░██████▐▌██████
█████░░░░░░░▀█████
██████▄▄░░▄▄░░██████
████████░░▀▀▄██████
████████░░▄▄▄░░█████
██████▀▀░░▀▀▀░░█████
█████░░░░░░░░█████
░░██████▐▌██████
░░░██████████████
░░░░▀██████████▀
░░░░░░░▀▀▀▀▀▀
░░░
||
Personal text: suggested by @joeperry

Personal Text: Africans on forum, click my profile website
Website link: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.0



After  sometime, d thread come dey go well, and @ CryptopreneurBrainboss come think am say e go better make we fight first for we own board den we fit later join fight for other african country board dem. E also noticed say everybody wey dey talk for inside d thread, na mostly nija people, so e come decide say e go change d name of d thread to Nigerian Bitcointalk Community Hangout. and dem come accept just two languages for dis thread wey be ENGLISH AND PIDGIN

Read am for here, why e change d name:
So see wetin happen wey make thread don change. We Nigerians we sabi carry Africa for head but others no dey reasons us like dat. E come be like we dey waste our time for here as na only we we dey here. Some people come reason me say make we fight for our own first then we fit fight fight for odas and I come see sense for wetin dey talk na e make I sharp sharp change the thread to focus more us, Nigerians.
As e be now eh, the agenda never change as na to get our own local board be the priority, if we fit achieve am everywhere go strew for us. We just need to dey very active atleast once a week for the thread and contribute towards the matter wey we dey address.



Times pass and d local thread don show better statistics and more active members Don turn up in the past few months
Some of d active users wey dey d old thread in 2021 quote from lordhermes. [members upward]
Edited by me
Code:
Active users
_____
1. CryptopreneurBrainboss
2. Becky666 [color=red]Rip[/color]
3. Mpamaegbu
4. Yourhomeboy
5. Sharon121212
6. Upgrade00
7. Leonardo7
8. nelson4lov
9. Soldierswitlittlefaith
10. Gozie51
11. posi
12. Charles-Tim
13. Josefjix
14. Alobo Realer
15. Maestro75
16. BIT-BENDER
17. Oshosondy
18. gabbie2010
19. Lordhermes
20. GeorgeJohn
21. Smartvirus
22. Traderbtcc
23. abdulodoi
24. awawo
25. Fivestar4everMVP
26. Miaallen
27. Blackpussy
28. BIN-BIN
29. ololajulo
30. CryptocurencyKing
31. Crptomagma
32. Onuohakk
33. Pokapoka124
34. thereader
35. igehhh
36. Lmaooo
37. Coyster



So with dis turn up from our naija people Dem, our oga @ Charles Tim con create d 2nd request for we local board on d February 07, 2021. Dis request again see many supporters because even Dem oyibo Dem notice say d naija thread show many positive movement and many new posts don dey created for d local thread in d past few months.

for e request, e also talk say make admin still give us some childboard and dis was d first request for we nigeria childboard

Child-boards
  • Altcoins
  • Marketplace
  • Off-topic

D request was still not granted, dis wan na becos Dem say d local boardthread speack more of English pass pidgin and also d activity from d local thread still no reach to tay open Dem own local board. Some oga Dem con advice say make we people Dem try keep d board more active and if d statistics show more activities maybe den admin go reason d request.



I think the reason why the request was denied in the past is because all of the Nigerians On Bitcointalk speak English and admins probably didn't think a Pidgin English board would have many users. But if the number of Nigerians is much higher now, it makes sense that you guys have your own local. However, if your local would allow users to write in English as well, the admins might turn down the idea. A Pidgin English only local would have better chances.

Discuss among yourselves how you would like your board to look and what sub-boards it should have. That helped the Croatian community get new sub-boards a few months ago. Those ides were then presented to theymos and Cyrus and the new boards were created.  

I think it could help to see how many Nigerians there actually are and how many of you are active on Bitcointalk.If the numbers aren't as high as they should be, maybe an African local could be an alternative option. In that case, you have to agree on which local languages would be accepted.

Good luck with the request!



@ Charles tim, on  22, September 2021,con think say e go still good, if admin pin d local thread for top of d local language board just as many other board do Dem own. Dis idea, we e say na other member give am con dey very good. dat one na because e don notice say other thread Dem wey no dey active reach we naija thread just dey block road for we thread to dey top and if our own no dey top, some members no go fit see am. e con create e Request for pinned Nigerian local thread make admin for pin d local thread.

Quote
Recently, one of the veteran members hinted me to first seek for our local thread to be pinned, that it should be what we should first seek for, that later we can seek for a local board. I have sent pm to Cyrus before, and I believed one or two members might have sent pm to Cyrus about our local thread to be pinned (just a guess). That is why we think sending pm directly may be inappropriate because the thread has not been pinned ever since then, that is why we want to make it official and public on meta board, we highly hope the Nigeria local thread will also be pinned.
Nigeria local thread is one of the most active thread in the other languages board but yet not pinned, there are 22 threads pinned while 21 are local threads, some of the local threads are not even active but taking up space while making Nigeria local board not visible as it should be, that is the reason we are now requesting for the thread to be pinned.

Shockingly, dis request no take time at all. Admin approved d request, con pinned d local thread put for d other local languageboard on 23rd September 2021. dis one con be happy moment for everybody for we local board as na e be d first request wey Dem approve for us.

A message from Cyrus to CryptopreneurBrainboss
Good day Admin, I would like to request for the Nigeria local board (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.0) to pinned for more visibility. If there's anything I'll have to do or the community will have to do to achieve this please let me know, thank you.
Regards,
Brainboss.
Hello,
Done! Sorry for not doing it by now. I'd suggest renaming the thread to match the standard of the rest of stickied threads.
Best,
Cyrus.


Na so d year 2021 Tay end and admin Dem no still give us we Nigeria board.So far, our oga Dem just come focus on trying to increase our local board activities and speck more pidgin as a suggested by other members.

After a while, d request thread by Charles tim don almost dey forgotten, den @ Mpamaegbu con decide to bump d thread again in April  2022 Dis bump wey e do, na to tay remind our admin Dem say, we still dey in need of d local board and hope say Dem go still approve am.

So far over d month, naija thread con show better improvement and when @ Rikafip con do he monthly statistics, e con see say naija don climb go up as d 11th most active local thread for d last few months.dis wan na better improvement




E don reach 9 month, since d last discussion about d nija board don happen and no reply from d admins. So far everybody don relax come dey do Dem best to keep d local thread active. Then one faithful morning;

Na for d early hours of d day, December 21, 2022, 06:05:53 Am,  our oga @ CryptopreneurBrainboss come bring great new for d local board. Finally d long awaited local board was approved and created by admin theymos. Dis news was a wonderful celebration for d Nigeria community.  At last, admin con see say we too need our own board and use am Tay do Christmas for us. D whole local board happy and con dey thank theymos for dis wonderful thing wey e don go for we Nigerian people Dem.

NEW TOPIC: Congratulations everyone, we made it, welcome to the Nigerian (Naija) Local baord.
I wan used this opportunity say thank you to everyone of you that contributed to the success we'll be celebrating today, the creation of the Nigerian local baord. Like play like play, I gat message wey come from theymos few days back asking for recommendations on how the Naija board go be like, After some deliberation with some members (Igehh, Charle-Tim & Mpamaegbu) and few questions answered to theymos, we decide to allow theymos freestyle the whole thing. And today we have the Nigerian local board. No subbaords were created but just the official language which is Pidgin and English.

Although d sub boards as requested no dey but, it was at least a gift worth acknowledging.
After sometime, our oga brain boss, come first lock d local thread say talk to say make people dem for fit go dey post for d main local board till further notice.
Click here to read why
The naija Local thread, was later edited by our oga @ brainboss to Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. dis one wey e do, na for our newbies dem to take introduce dem self and avoid spamming d local main board with many introduction topics.





Well, dis na d history of how our local board Tay come into existence, thanks to great legends like Igehh, Charle-Tim, Mpamaegbu, CryptopreneurBrainboss for Dem great efforts so far. Abeg make una dey try give these men all respect even though Dem fit no senior u for age, but if no be Dem, we for no dey here today. I greet una bosses Dem and thank una for una good work and effort so far.


Some other requests by our naija local board;
Proposal For Naija (Nigeria LB) Sub-Boards Creation by Agbe

Request for merit source;

Charles-Tim merit source application + Nigerian local board
Igebotz Nigerian Local Board Merit Source Application
Upgrade00 - Merit Source Application



List of important dates to note on nija board




Donation threads done by some of our early people dem
A Crypto Christmas; Using Bitcoin to help feed the homeless by satoprincess

Project Covid-19: Supply to 50 (Now 70) families in Nigeria, Images {Donate👇}by CryptopreneurBrainboss

Projec Covid-19 : Supply to 20 families in Nigeria (Completed successfully) by CryptopreneurBrainboss

I Have Donated My Campaign BTC to buy Laptop for Practical Classes by Agbe



Quote
abeg, if my our oga Dem see or know of any thing we no dey here, abeg make Dem notify me for dis thread. And if I give false information abeg make una still talk for here. Thanks for reading
We that just joined the Bitcointalk newly will not actually understand the fight our moderators fault to see that our great naija local board is standing right now and only standing but the local board is gradually growing to an extend that it will be favourable to the members of this great naija local board, I believe that the moderators are still working to add more values to the one have done, I'm so glad to be a member of this great forum, it is always good to create a good thread for us to join ourselves and interact with one another and i believe that know one knows it all, and i believe in this thread we are going learn many things that guide us in future.