Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: No such thing as a Perfect Strategy in Trading
by
GIF-JOBS
on 28/03/2025, 17:44:23 UTC
This na wetin newbies never ready to listen and learn, they are still carried away by the illusions that once them pay for signals, them don become rich. Wetin dey truthful be say, person no go teach you wetin dey give them money, them go silently dey do their trading dey go not minding the fee from anybody. Na person wey no get money, dey arrange group to dey use deceive en members by dropping signals or even teach them trading.
Na so one of my friends tell me yesterday say e wan start trading, and e don already deposit $500 for him account, I come ask am whether e get any trading experience, e tell me say no, but e get one of en friend wey sabi trade and say e go mentor am, say the guy dey make daily profits and say e don turn $500 to over $1k in less than few weeks.

Funny enough, na so many newbies feel say e dey easy to make money for trading, simply say them see person wey Dey do am and the person offer to teach them. Trading na something wey go take you years of experience before you fit Dey make money from am, but during that learning stage, whether them give you signal or not, just prepare your mind for losses cos e go Dey come steady.
Most new traders come to trading hoping to make quick profits like this, they think it is very easy to make money from trading, they will go trading with $500 now, their boss will give them a signal, according to that signal they will trade and increase their money by 2X or 3X, in fact the easier it is to think about it, the reality is much more difficult. As easy as they think about making money from trading, it is not so easy to make money from trading. The depth of trading is very deep, without deep knowledge, you can never make money from trading, no matter how much they think about the signal, if you do not have your own education, nothing good will ever come from such signals. The possibility of loss is more than the possibility of profit in trading, so it should never be thought of as that easy.