Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Mistakes wey people Dey make for trading
by
Cummingbird
on 02/04/2025, 17:19:56 UTC
So lately I Dey see many post about the comparison if gambling and trading, our problem be say we nor wan learn we just wan earn , because we Dey see traders life style via social media , so we come picture trading as means to get rich quick not knowing “ is the  hardest way to make easy money “.

I Dey talk base on experience when I start trading back then I nor bother to go deep in the learning aspect I just go for the basic knowledge, with the mindset of if the price come down I go buy if e go up I go sell after everything I end up regretting my actions after countless losses if nah say I calm down learn first I for nor go through those kind losses .

We just wan go the destination without knowing or experiencing the journey, all successful traders went through this stage you are in now before getting where dem Dey so , Dey  pass through the journey .

So drop some mistakes wey you know shey people Dey make for trading well well if you get any .
First of all trading is not a way of making easy money, when your risking money to get money, you call that easy?
But sha one mistake i know sa i been do when i been de learn na to underrate the power of back testing, some traders just learn from people or youtube and they think their good to go, but i no lie give you even back testing the charts will teach you more than you more than you can ever learn from someone, i was really finding it hard when i was learning until some one asked be "bro de you back test at all" i been lie sha, i talk yes when i know deep down that i dont, when i reach house i con reason am sa this backtesting of a thing self go fit help me ooh. once i started backtesting from past results the way i viewed the market changed a lot, it was asif i opened the secret to profitability.
So i will advice every one that is into trading to invest more in backtesting the past results instead of wasting your money on some mentors that at the end of it all you will not achieve any thing from them.