So lately I Dey see many post about the comparison if gambling and trading, our problem be say we nor wan learn we just wan earn , because we Dey see traders life style via social media , so we come picture trading as means to get rich quick not knowing “ is the hardest way to make easy money “.
I Dey talk base on experience when I start trading back then I nor bother to go deep in the learning aspect I just go for the basic knowledge, with the mindset of if the price come down I go buy if e go up I go sell after everything I end up regretting my actions after countless losses if nah say I calm down learn first I for nor go through those kind losses .
We just wan go the destination without knowing or experiencing the journey, all successful traders went through this stage you are in now before getting where dem Dey so , Dey pass through the journey .
So drop some mistakes wey you know shey people Dey make for trading well well if you get any .
Normally trading na very profitable career wey dome people don build their life around and till tomorrow sef the market still get major opportunities to profit traders the matter na just that people no wan spend time learn the basic and how to make good analysis. Though some times some people dey put in so much effort but yet dem never blow, that one na just because them never mater their psychology well, the market sef fit dey maniputed by some whales but no matter your loses if you don good e go dey very minimal. Trading is profitable just the e still get some kind features like gambling an why many people dey compare the two because all of them and based on probability weda e fit happen, nothing dey sure 100%.