This one na very good initiative, one wey me I believe say go really help build our Nigerian board to a higher standard, congratulations to you @Floxynice, our people dey make parable say, "person wey them tell say make him continue as he dey do, e mean say wetin him dey do dey good, but person wey them tell say make him stop as him dey do, e mean say wetin him dey do dey bad"..
Me I talk say make you continue as you dey do, carry go with thing wey you don start, na really good stuff.
👍👍
Naija nor dey carry las. Abi nor be so we dey tok am.
Anyways, it is a well welcomed initiative. This is a non-collateral loan? Think am twice first o. We nor wan hear say dem shot bird him mama fly.
Also, i think say if them send you PM make dem still put am a thread wey people go see. That one na still kind of evidence say this person collect money. You see at the other guy take dey do him own.
Make everything dey public. Na you go sabi how to take do the name thing for privacy sake. Na my own be this.
Wetin you talk make sense, I believe say person fit just post him name and the amount of money he's applying for, when op see and approve the loan here on the thread, then the user can then send his or her account details to op through pm for privacy purposes.