Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 3 from 1 user
Re: Invest in bitcoin or save your money in the bank.
by
CryptopreneurBrainboss
on 10/04/2025, 17:20:48 UTC
⭐ Merited by Umulala-alala (3)
If you check, na why e talk say, e depend on the plans you get for that savings and how long you wan save am, this is why e Dey good to get emergency funds, so that you no go need to go run meet your investments or savings anytime wey you get emergency or money wahala. But if you no get long term plans for that money, then the bank na e be the best option to save, so that anytime you just need am, you go just go there go collect am without stress, and you no go Dey bother whether btc dey go up or down.

Better truth dey this matter as no be every cash wey person supposed to invest. We no suppose dey put all our eggs for one basket but separate them to avoid any complications. As you get dey invest for Bitcoin, make you dey get savings too.

Na that savings go give your investment money enough space to do well because the more you get funds to handle any business wey come up, the better for the investment as e go ust dey grow with time.

Wahala money dey very important pass anything because that investment wey you dey run so, you no even sure if na sure plug and irrespective, anything fit still happen wey go make you lose all your investments then and if you no been get backups na there problem go begin to start from as you'll now have to start from the ground to build yourself up without any financial backing.