Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: African Proverbs in Pidgin
by
Sexylizzy2813
on 11/04/2025, 23:10:41 UTC
I don come across this your reply for days now, but i just they try see if i go fit read another better meaning, i catch the flow for wetin u talk so, i take the meaning too centered on Food > Resource > Money, which no fit into the exact meaning.

Well done @Mpamaegbu, sometimes when you begin give responses i dey feel like say you done dey operate on walking stick, like them with grey hairs. I go edit older post for clarity as others fit come across am.

Mpamaegbu na one of our community Chief nah, sometimes I wonder why una never fit notice am, person wey use proverbs and meanings take end meeting wey them hold wey last for 5hrs. The way this man dey arrange him own proverbs you go think say him get book for all of them but na the grey hairs (like you talk) dey give am inspiration to bless our own knowledge with more knowledge to take hold body.