I see this news on Friday about CBEX when people come the talk say the platform done crash and people done lose all their money them invest inside. For those way no know waythin be CBEX, it stands for China Beijing Equity Exchange. According to them say nah digital asset trading platform way you fit dey trade. But plenty experts done the warn say the platform gets all the look-alike of a Ponzi scheme just as MMM was. Now since Friday 11th April Investor never fit withdraw their money and the platform the drop message say nah till 15th April them fit the do withdrawal. Somebody now the cry say him no fit withdraw him $60,000 him put inside and many others too.
If we get anybodi here wey be victim of dat CBEX nonsense, we supposed pour am water wey pepper dey b4 we wipe am 2 by 2. I nor get single sympathy
to waste onfor anybodi wey fall for Ponzi bc most of dem dey get idea wetin dem dey do and go still chook head put. These people want fast money
and dem. Dem dey neglect the process of sowing and harvest seasons.
A few years ago, e get somebodi wey dem introduce to me to teach how dis whole cryptocurrency thing dey be, especially Bitcoin so dem go fit invest. D persin ask me how long e go be b4 dem fit see profit comot
profit and. I tell am sey I nor know. Na im d persin open up to me sey d type wey im dey like na dat type wey dem dey invest and within 2 weeks profit don show. I told dem sey na Ponzi be dat and they said no problem as far as money dey
anam. I open mouth.
Ponzi victims are greedy set of humans, not risk takers.