Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: African Proverbs in Pidgin
by
Pokapoka124
on 14/04/2025, 16:57:08 UTC
...but the way e dey go e come belike say people dey repeat wetin others don yan before.
You dey observe well. E don tey wey I don begin observe am sef and d thing dey vex me as I nor do am self–moderated wen I start am. Since dem wan begin spam here, I go begin strike dem posts out soon. Again, anybodi wey give yarn wey nor interprete well fit also get d strike going forward.
Normal level. We don tay for this thread, make person nor come rubbish am for us wey dey enjoy am. Person been dey suggest say make we pin the thread for the local board based on wetin the thread represent for us but as people dey spam am so e go hard. I never see you comment for the thread be like you never see am.