Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: What you guys think about pi listing
by
Son Of Blockchain (SOB)
on 19/04/2025, 11:48:41 UTC
⭐ Merited by Rockson1 (2)
~snipped~
Make we no use because say them pay begin they see them as legitimate because say every scam once started as legitimate.
Na true you yarn there sey every scam dey everly start as something wey dey legitimate. Shebi na so this latest CBex scam take start too. Anyway, make I nor even carry talk enta dat wan now. Back to Pi. I follow chop small there but nothing much. I nor start early like many bc I reason am sey e defile most things wey I sabi for dis industry, especially as e dey ask for personal data. Na until I begin see where dem dey trade am I begin put interest late 2023. So, I nor start on time. D listing price in Feb nor be wetin people really expected but e still good if we check d huge maximum supply we e get. Maybe d devs go need burn some tokens so price go fit go up well.

Somethings wey una done talk no be lie, for the industry scam coins dey too but no be every project be scam and also make una try dey read the white paper of any new project wey come on-board so una go understand am well so you no go call all of them scam including the ones wey come with em own opportunity.
 From wetin I know Pi never show any scam features nor defraud anybody for em community, they ask for personal details during KYC so one person no go get multiple accounts and according to the white paper, mining go still dey on for like 6 months after them launch so maybe na by them dey go burn some tokens, according to the white paper. The only mistake wey some Pi community members do na to hype the coin say eh go high pass Bitcoin for future, come launch at  $314,159 wey dem claim say na GCV price (Global Consensus Value).