Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: E get any risk if person dey always trade with one P2P merchant for inside excha
by
Curious T
on 24/04/2025, 11:17:46 UTC
Them go get Ur real name from you account and also dem go get your phone number. I no no if you de aware sha but U fit get pesin name from him phone number without WhatsApp sef. E fit no mean sha oo depending on you but personally I no like local exchange like that.

Some merchant dey like ask for phone number so them fit call you in case you dey delay to release coin, so e no necessary say na person wey you dey deal with steady alone go get you personal details. Even without dropping your phone number most people dey use online banks for P2P transaction and most of those banks dey use phone number as account number, so your phone number dun already dey exposed.
If you use traditional banks, for the account number alone sef, them fir get your real name so I no sure say these na wetin person suppose to dey look because all these information dun already dey exposed one way or the other when you do P2P trading for exchange.