Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: E get any risk if person dey always trade with one P2P merchant for inside excha
by
Johnlomape
on 24/04/2025, 13:39:59 UTC
Wetin fit be the possible dangers of doing P2P transactions with only one merchant for these centralized exchanges wey still dey function like ByBit, Remitano and the others? I dey curious because aside say one or two small price difference in kobo, e get any danger?
Them go get Ur real name from you account and also dem go get your phone number. I no no if you de aware sha but U fit get pesin name from him phone number without WhatsApp sef. E fit no mean sha oo depending on you but personally I no like local exchange like that.
So tell us which better exchange you dey use whether we fit join too to trade there. No how no how, person must use centralized exchanges because we gat change crypto to naira  especially those of us wey dey gamble for Stake using cryptocurrency.
If you get better exchange, I go like make you show us sha, na the best I dey find we get limited scam users. I know say scam dey many exchanges but we fit avoid am when we try to use the ones wey get small scammers there especially exchanges wey dey very strict against scammers. This one go help genuine traders exchange there money to naira without wahala.