Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Mistakes wey people Dey make for trading
by
Rgram
on 24/04/2025, 14:33:12 UTC
So lately I Dey see many post about the comparison if gambling and trading, our problem be say we nor wan learn we just wan earn , because we Dey see traders life style via social media , so we come picture trading as means to get rich quick not knowing “ is the  hardest way to make easy money “.

I Dey talk base on experience when I start trading back then I nor bother to go deep in the learning aspect I just go for the basic knowledge, with the mindset of if the price come down I go buy if e go up I go sell after everything
 I end up regretting my actions after countless losses if nah say I calm down learn first I for nor go through those kind losses .

We just wan go the destination without knowing or experiencing the journey, all successful traders went through this stage you are in now before getting where dem Dey so , Dey  pass through the journey .

So drop some mistakes wey you know shey people Dey make for trading well well if you get any .
Yes very true o..
Same thing affected me that initial time I start to trade, as if that one no Deh ok, I con start to dey find signal groups everywhere which helped speed up my loses and I almost start to think say trading na scam..it was later I come say make I calm down study am the same way these traders study am, it may take up to two, three or more years but once you get am clear for brain you go start to make profit, no be say you no go Deh jam loses every now and then for the market o but studying go help maximise profit and minimise loses and overtime.