2) Always confirm the name of the sender when you receive alert if it matches with the name of the person that is supposed to pay you.
We nor go ever over flog dis issue even as we sabi sey dis matta don com LB before and d reason be sey na to save awa people 4rm scammers. I choose to put mouth for dis point bc e get as e bi and na im be d wan wey fit even bring persin leg out for wetin im nor know. E fit land persin for serious gbenge. Make I tell una as I dey take handle dis wan. For me, e dey important to always check merchants warning for dem page b4 we deal. I must see, "I Don't Pay to Third Party Account" or "No Third Party Account" If I nor see am, I skip d merchant.
I nor dey even consider those wans wey dey write, "I might pay from my cooperate/business account." Even if dem like make dem write d business name there, e nor concern me. What if something sup and dem delete d business name wey dem write there? I dey like persin wey submit im own name like me too.
Make we nor dey always consider rates to overlook most of dis vital signs.