For about four months now, peace don return for Birnin Gwari local goment area of Kaduna state, northern Nigeria, afta one peace agreement di state goment reach wit di bandits wey bin dey terrorize di area. Di bandits bin agree to drop dia arms and stop dia reign of terror for in and around di state.
For dis matter, some security experts dey see am as beta development if dem put correct measures in place, e fit bring lasting peace for di northern region wey don dey battle insecurity for ova ten years.
My brother, e get wetin sani abacha talk when he was the head of state for we country naija, him say any serious security lapses or any arm group for we country wey terrorize the state for more than 24hours, just know say government hand dy inside.
Bro for we country we no dy stupid, we know everything wey dy happen around us, who give those bandit weapons if no be the same government and their officials?
If government really wan end banditry, them go do am without stress because northern Nigeria na dry land, e no go hard soldiers to do their jobs effectively like here wey be niger delta wey na river, and you and I know say to operate for river na no man's land, so e no go worry them if them truly wan end banditry, I just see this as one way them wan use chop money, because if no be money wey them wan just chop, this war against banditry for don end tey tey no be today.
And lastly, see as our government dy easily pay Money to all this bad guys wey dy give them problem, this one no be dangerous pre-incident them dy set so?
Because them they indirectly tell us say we wey no put hand for bad thing no get sense, tomorrow now more arm group go emerge because of say government go later pay them for them to calm down, which to me e no dy fair to the good citizens of the state.