I know say plenty other ways day to avoid p2p scam you fit still add your own make all of us learn then make progress together.
Make I add say anytime wey you dey high on anything, no run any P2P transactions. You fit make mistake because you eye don dirty. That time, 20k fit bi like 200k for your eye. If you no say your head full and you want run transactions, abeg call somebody wey you trust make them help you confirm the deal. Like me, I dey like call person to confirm the payment because if you no dey careful your eye fit deceive you.
Dis one follow for the main Koko infact we no supposed carry dis particular update play because when man eyes don dirty you fit dey see 3 put e go dey you like 33, to avoid something way go make person vex or feel pains make person forget about transaction if you no say nobody dey beside you way fit assist you to run am.
One time like that I run p2p for one exchange I know understand wetin be fast trade and my eyes been day some how but as I run the transaction na so the person pay the money within 2 minutes and I rush release the coins when I get the alert but na later I come realize say instead of #1400 per usdt na #1200 Dem pay me because of the option of fast trade wey I been choose.