Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Negotiations for peace deal wit bandits go fit solve Nigeria insecurity palava?
by
Stable090
on 15/05/2025, 23:07:40 UTC
For about four months now, peace don return for Birnin Gwari local goment area of Kaduna state, northern Nigeria, afta one peace agreement di state goment reach wit di bandits wey bin dey terrorize di area. Di bandits bin agree to drop dia arms and stop dia reign of terror for in and around di state.
How you go sign peace agreement with bandit? D talk no really make sense to me now, I Dey sure say as d government Dey sign peace agreement with bandits, government go give dem money, so even if d bandit calm down for that moment, later in d future, dem go start again, and money wey d government use settle dem now, na him those bandits go use buy weapons wey dem go use fight back if dem wan come back.

Bandits no be people wey we suppose even think say dem go get peace agreement with, if government Dey get peace agreement with bandits, then group of people go just Dey come up, and Dey go Dey create problem so that d government go Dey get peace agreements  with them, dem go Dey use d money Dey survive, if you call people bandits, dem u suppose fight them, no be say you suppose Dey sign any peace agreement.