~snipped~
...you no go even need person to tell you say we dey bull market because the evidence go dey everywhere market go just green like say na football field.
You really captured dat scenario wella here as you mentioned, "green like say na football field" Na so e dey be. Dat wan na during d excitation stage market dey be like dat and na FOMO dey cause am. But Brainboss, you
setsef look am well na, u go agree wit me sey we already
don dey bull run oh. E even started late 2023 in preparation for pre-halving wey we experienced in 2024. In fact, na around $32k I start to observe my own sef. Maybe wetin most people dey call bull run na dat FOMO and excitation wey dey make market go gaga. E go soon happen dis year. Newbies wey nor listen na to buy small keep go cry had I known.
BTW, I nor know why e bi sey anytime wey I see CRV for aggregator sites I go just rememba u. Shey u still hodl some of dat token (Curve DAO)? E bi like it's picking up now.