I have noticed a recent observation in this our local board, and I will like to share it to see if someone else has observed it too, and also so that it can be corrected and an attitude that should be fixed.
Many of us feel that there is a potential to only earn merit from the merit sources here in the local board when you start a topic, not when you engage in another topic or discussion that has already been started. I dey see many topics wey engagements suppose dey, but as we plenty for here, engagements go cun dey few. E nor too good like that.
Let us try engaging in topics created even when we have topics of our own to start.
The more we share our knowledge on topics regarding bitcoin and cryptocurrency, the more many of us learn from each other based on our different perspectives and unique mindsets
I get wetin you dey talk for this your observation na something wey me I noticed too... The new ones wey come need their thread to boom small at least make e show say somebody open thread and make e show say this particular person wey open the thread follow for this LB, but one thing is for sure, is like our
LB get two branches, the head and the tail and for the head if them open thread na only the ones wey feel like dia own too good especially the higher ranked ones nai go make the thread get plenty engagement as you call am but if na the tail wey open thread engagement no go reach any where. Is like this LB is divided, remember when I first come here you go see Sr, Hero and Legendary Members go engage on thread wey the newbies, member and full members even Sr Member open back them this area dey sweet to come post but now e be like house wey water full.
Without engagements, the local board no go grow and make the engagement no just be about completing our post quota but more about we being interested in what's being discussed. We don't have much high-quality threads on the local board and this na because the topics being created are mostly about generic stuffs that add no value to the board. I no dey say make we no create those types of post but make them reduced and more of educational posts. Don't bypass a quality post only to reward people you know because that's a big problem in the board. Make we all put hands together and we go get the board lively again.
Oga Brain, I get where you dey drive at but march brake, about some people wey dey post to complete weekly quota, e dey happen but e no good. No forget say some people stop to post here becos that thing wey been dey give them joy to post here no dey again. No lie oh, if you see where honey dey rush from shey you go continue to go their to fetch from (this question na for you alone)? I believe say you go continue to go their but when you no dey see wetin wan make you go dia I no sure say you go show face for that place, that's how some people dey feel nai make them dey avoid this place while some no see that joy of coming here again, as the leader wey me I see you as or una make una reach out to some of us wey no dey near here ask them why them no dey near this place to post, I know one person wey I never see lost here since I sabi for this Forum I no go mention the user but go ask them some reasons go shock you or una wey be the head. As for the Post you talk about na something wey many of us including me need to work on, here sweet but I.T.K don dominate this place, we lack many things for this place.
Support PIGIN For Our Local Board...