As I take think am, e no too make sense say we go dey form like say na oyinbo place we dey, when be say we suppose dey run our things for ground level. As we dey yan our kripto matter, make we try keep am for that our own level — the one wey everybody go feel, enjoy the gist, and still make us unique on the low.
Abi how una follow reason the matter?
Judging from the day wey you create your account @ O.P, e dey obvious say you no be knew person for this we forum, and as such, this na one issue wey we don talk over and over again for this our local board, and we been don generally accept say both English and Pidgin English is accepted for discussion for this we local board, because I dey very sure say despite all of us been Nigerians, I dey sure say no be everybody go dey good at starting a written conversation in pidgin language, and in other not to exclude those people, we been don talk say everybody is free to use either pidgin or normal English, inasmuch as we dey discuss things that has to do with Bitcoin and our country Naija.