Original archived Re: My thought on what a local board should be!!
Scraped on 30/05/2025, 11:52:27 UTC
I just reason say this our board na for we wey sabi yan Pidgin well-well. As I take see am, if person wan drop post wey go follow grammar style, e for better make e carry am go the general board. I believe say the people wey push make we get this board do am because dem believe say we go fit express ourselves the way we dey normally dey talk.
Tru Tru talk, e gud say wen e cum to awa group affairs, make big big grammar no follow becuz pikin no go dey with papa come dey funeh giam.. buh dey only tin bi say anybody wen wan post make they make der message clear for ears. So dat e go dey easy to communicate and also wen e cum to bitcoin nah serious mata,, if dey message no clear pesi fit misunderstand you and rison anoda tin entirely. Our local forum nah for only we naija and nobody weh no fit spik pigin except you be correct oyi ocha weh dey pretent to skul abroad. As for me brokin sweet to spak or spok especially wen you dey with correct guy men wen dey rison business mind always.
As I take think am, e no too make sense say we go dey form like say na oyinbo place we dey, when be say we suppose dey run our things for ground level. As we dey yan our kripto matter, make we try keep am for that our own level — the one wey everybody go feel, enjoy the gist, and still make us unique on the low.
Abi how una follow reason the matter?