Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: My thought on what a local board should be!!
by
SmartCharpa
on 30/05/2025, 19:38:28 UTC
I just reason say this our board na for we wey sabi yan Pidgin well-well. As I take see am, if person wan drop post wey go follow grammar style, e for better make e carry am go the general board. I believe say the people wey push make we get this board do am because dem believe say we go fit express ourselves the way we dey normally dey talk.

As I take think am, e no too make sense say we go dey form like say na oyinbo place we dey, when be say we suppose dey run our things for ground level. As we dey yan our kripto matter, make we try keep am for that our own level — the one wey everybody go feel, enjoy the gist, and still make us unique on the low.

Abi how una follow reason the matter?

The truth he say you cannot blame people the way they choose to speak in this local board, majority of our people prefer to dey speak English other than pidgin because to write in pidgin many people dey see am as stress, so they find it easy to type with English. Na better thing you talk Op because some other boards dey create post on the level wey their people go take understand because pure English no be everybody language and some newbies take find it difficult to understand some threads.

However, Op I understand waiting you dey try talk because I can relate too, this kind attitude no dey only happen for forum, even like school e dey happen, you fit see some guys wey be the same language with you but over sabi and big boys wey dem dey feel no allow us to claim our language again and that one fit make person miss some kind opportunities for life.