I just reason say this our board na for we wey sabi yan Pidgin well-well. As I take see am, if person wan drop post wey go follow grammar style, e for better make e carry am go the general board. I believe say the people wey push make we get this board do am because dem believe say we go fit express ourselves the way we dey normally dey talk.
As I take think am, e no too make sense say we go dey form like say na oyinbo place we dey, when be say we suppose dey run our things for ground level. As we dey yan our kripto matter, make we try keep am for that our own level — the one wey everybody go feel, enjoy the gist, and still make us unique on the low.
Abi how una follow reason the matter?
This matter no be today them don raise am up and in the end, na still wetin the rule be for the Naija board we go still follow. Me I understand your own point of view and it’s okay to feel like that base on say na wetin other local boards dey do, but I still hear say them get some local boards for this forum wey still dey use English for their local board even though their own na official language e be sef unlike pidgin wey no be our official language yet.
Sometime I go wan write with pidgin but base on the flow of wetin dey my head when I don write for general board or wetin OP use take start the topic, I go just continue dey flow in English even if I want make e dey be say I dey use pidgin for here mostly. Last last, nothing spoil for all this thing as far say we dey communicate and understand each other well with any of the two languages wey we dey use here.