Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: My thought on what a local board should be!!
by
Makus
on 31/05/2025, 04:51:39 UTC
I just reason say this our board na for we wey sabi yan Pidgin well-well. As I take see am, if person wan drop post wey go follow grammar style, e for better make e carry am go the general board. I believe say the people wey push make we get this board do am because dem believe say we go fit express ourselves the way we dey normally dey talk.

As I take think am, e no too make sense say we go dey form like say na oyinbo place we dey, when be say we suppose dey run our things for ground level. As we dey yan our kripto matter, make we try keep am for that our own level — the one wey everybody go feel, enjoy the gist, and still make us unique on the low.

Abi how una follow reason the matter?

I no go lie say I no understand wattin you dey talk brother, but the truth na besay, topics like this been don exist before and we agree to make the local board both English and Pidgin language reason being that no be everybody dey fluent in writing with pidgin,  so na why, male e no come be like say we leave some people behind, the most important thing Is that we have a place where we can call a home/local board rather than being merged with several other countries. So just know say even in times to come dem no go fit change this rule of language usage as far as this local board is concerned.