I just reason say this our board na for we wey sabi yan Pidgin well-well. As I take see am, if person wan drop post wey go follow grammar style, e for better make e carry am go the general board. I believe say the people wey push make we get this board do am because dem believe say we go fit express ourselves the way we dey normally dey talk.
As I take think am, e no too make sense say we go dey form like say na oyinbo place we dey, when be say we suppose dey run our things for ground level. As we dey yan our kripto matter, make we try keep am for that our own level — the one wey everybody go feel, enjoy the gist, and still make us unique on the low.
Abi how una follow reason the matter?
E be like say you dey miss the point wey make @Igebotz and other brain wey follow create this forum take start am. We dey local board no means say person no fit talk English if na wetin him Sabi. You feel say na every Nigerian Sabi Yan for Pidgin English? No be so!!!
Wetin matter be say person talk wetin another person fit understand. For local board, na to help bring we own closer wey you go feel among. A place wey be say if you Yan for Pidgin English another person fit readam understand. E get wetin no good say person dey where he no know anybody, you go just turn total stranger. Make we no come carry say person dey write grammar come begin dey discriminate am. Abi you no know say e get people for this country wey come from better family wey be say if you Yan them "Wetin dey sup", they go just dey look you like mum. E no go make anyone talk say they no be our members again. Make we try dey accomodate everyone, if you Sabi pidgin, Yan; if you Sabi grammar, blow! I rest my case!!!