Look up the stats of this post you'll see the ton of views replies won't come in why because they are all gang members funny thing is some will be shameless enough to come say something here knowing fully well they are aiding this shit.
Na why I talk for my earlier comment say, the ruling way you give in the beginning go make people no really speak their mind. People no dey wan openly be bad person or look like bad person o. That no still mean say, the other people na em better pass or you dey right even.
Charles_Tim bia come here na which time you take send your merit give people finish and then Mia Chloe no he only you be the first person wey dem give merit source to dey come talk this nonsense here.
Go and check Pakistan, Italian and other local board make you see their merit source dey do, u come dey shield urself by talking this nonsense.. evil man or woman claiming to be Saint.
No need to dey emotional my country person, na we we dey here, you fit call person out but, do am in a way e go push for intelligent discussion no be something way go wan provoke person. I no be any of this people way you mention and I like the bold move but e get how you go do am, e go dey out of place and make people dey defensive rather than to come reason with you/us.