E jus be as bible talk am say d poor go always dwell amongst you, the poor no b only for wealth Oo, Poor mindset Dey.
😂 I catch wetin u take style do there, and e enta well well. Na so e go everly be. Dat difference in mindset go continue to dey as long as man and indecision dey relate bc wetin separate poor people and rich people na decision.
Jus as our faces differ so does our minds differ, no matter the knowledge or experience people will always act different.
If e nor be like dat, everywhere go dey monotonous and boring. Na im make every human being though created in d image of God, still dey different for face, body and character. Na to drive away dat monotony.
These people godey reason say e better make dem collect small gains than to lose part of their money and this na cause of say their bitcoin knowledge Dey limited.
Even those with broad knowledge and understanding of Bitcoin still dey do dis wan. Dem go tell u sey "nobody ever goes broke by taking profit, no matta how small." Na dem defence be dat.