Like in this forum some users just want to rank up without going through the learning process,, they are always in a haste to rank up and most time they tend to give up early due to the process being slow to them. Same goes for those In trading , they are always in hurry to start making profit without having any solid knowledge or skill . Even in many aspect of this space , rather than trying to rush things take it slow and make it worth the time .
For dis life anything wey you wan do no Dey rush, make sure you do research first before you start, if you rush into something, and you no get proper knowledge about Wetin you Dey do, then you fit end up losing money. If you wan start to Dey trade, and you jump into am, make I no lie, you go lose money, na you wey run enter go still run commot. If you wan trade you suppose get proper knowledge about trading before you go put money, and if you put money, na small you suppose put just to Dey learn first, before you go increase amount wey you Dey trade with.
1. Have you ever made a rushed decision in crypto that you later regretted?
Na when i start to Dey trade na him I rush enter trading, but make I no lie you, everything no end well, because when I don too close money before my eye come clear, as I Dey think about the money wey I don lose, I come go borrow money say make I use recover money wey I don lose, make I no lie I still lose all d money, na that time I come stop trading, I see shege before I see money wey I borrow pay back.