~
..I go make complain seff dem tell me say in the next 7 working days I go see my money, till today I never see anything, that thing naim just make me abandon that bank.
Make we nor dey easily give up on stuff like dat. Na all these things dey make criminals for Naija dey get boldness bc dem believe sey most people nor go pursue their fuckup. If to sey dis ur case still dey fresh or you wan pursue d matta like dis, just go the bank social media handle; especially Twitter and drag dem there by also tagging CBN to it. Many people don resolve their issues with banks like that, sharp sharp. Once CBN dey tagged, banks dey quickly respond. Most of the things wey we nor know how to go about, e get people wey don do dem keep. All we need do na to search online for dem. Just a simple search. There are so much wey we fit take care of online without leaving awa house just by using awa phones.
Na better OT you dey yarn so like this o because person don tell me before say him go ATM machine go withdraw money but them debit am wey be say him no receive the cash from the machine and him don waka tire for yin bank make dem reverse the money say e no get head for more than 3 months and as e be like dis e fit say him don forget about the money for dem. All these banks sef follow for criminal activities if dem settle down check dem well and the most annoying part na their customer service, very rude set of people with their busy body. If e be say any bank wey dey do anyhow you come drag dem for social media say dem go attend to your demand e make sense like dat na. People wey still dey keep their money sef na i dey pity because for a very long time now my foot never step enter bank premises not to talk of entering inside a banking hall.