When people are unemployed after graduation, it doesn’t necessarily mean they’re not fit to be employed, it’s just that, in this country, sometimes even the best of brains with a first class degree can find it difficult to secure a job. And not just any job, but a well-deserving one that can sort vital bills.
First class for dis country now no mean anything, I no even see difference between first class, and other lower classes wey remain, because even if you graduate with first class now, work no Dey ooo, only if you ready to work with private companies then you fit get luck, and if you Dey work with private companies, you self no go get peace of mind because dem fit commot you for work any moment, and payment fit no really Dey okay.
I don even see some companies wey Dey talk say dem prefer to higher HND holders, or degree holders with lower classes, dem say if dem collect first class holder, dem go Dey expect better money, so d money wey dem go use pay one first class holder, e better make dem use am pay like 2 ND holders.
The truth be say for Africa as a whole, things no normal but e be like say Naija own dey another level. When I dey try enter school, they tell us say them dey always retain any body wey comot with first class or wey be best student for him set. Na so everybody face book dey read, everybody dey find wetin they go use retain am until we comot for school. Las las, all the people wey carry the first class comot, most of them never see anything to do now. I been getting one wey dey very close to me during service, for over 6 years now he still never see job, na for private secondary school he dey teach and you know as those school owners dey take treat people.
I feel say as some of us now don confirm say work no dey anywhere, na to dey advice others wey dey come up make wetin do most people no do them.
I first begin dey reason as I go take dey make my own money during my IT days. We first start with Ponzi, as e whine person finish, I run from everything wey concern online until after like 2 years before I begin enter crypto again. Life na jungle and na survival wey everybody dey find. E sure me say na Naija situation make 60 percent of everybody wey join crypto to join am. Na still the same matter carry people join gambling and betting to make a better life.