If you fit
1. Dey discipline when spending
2. Find works wey you fit earn in bitcoin or convert to bitcoin
3. Learn to hold and protect the bitcoin make scammers no collect your hard work from your hands
As this steps Dey simple so, na so is easy to start you ten years bitcoin investment plan and you will thank the day you decided to start.
You’re right my broda because for this bitcoin investment, make we remember say no be by force to dey invest all our money. E better make person get another source of income, so that if anything happen or you need money urgently, you no go rush sell your bitcoin at loss. When you get steady income from other side, e go help you hold your bitcoin well and give am time to grow without pressure. If you rely only on your investment, small thing fit make you panic and sell am for the wrong price.
And other thing be say, make nobody think say bitcoin na fast way to get money, the better success dey for people wey get patience and fit hold am for long time. All these people wey cash out big today, most of dem start many years ago and dem no shake even when the price fall. So if you really wan make good profit, you go need to calm down, invest what you fit hold for a long time, and no dey check price everyday dey panic like person wey gamble.