Normally investing in bitcoin or saving your money for bank get there own advantages and disadvantages, which I go list them here, so that you go chose wisely if you go take the risk grow your money, or you go carry give bank make them use an grow thereself from that bitcoin wey you dey fear to put money.
Sometimes we dey even make am look like sey d opposite of Bitcoin na bank or fiat. No, e nor be so. Just like d opposite of stand nor be sit or the opposite of short nor take be tall, or white nor be black. We just need to get that mindset corrected at once.
For my own part, I nor dey like leave money for bank sef even when I nor put am for Bitcoin. For Naija, inflation dey deal wit us well well and e go make sense make people nor dey leave dem money for bank. Instead, na to leave am for stablecoin. Na dat wan make sense die.