Op the main thing be say everybody want quick moni and if no be wetin person no go fit get that cash fast I no see we youth getting involved. Just like men wey like drink, if where them dey go no be where them go jolly drink and all that fun related them no fit near there at all. To learn hand work good oh but many people no really know why and na now them don dey see reasons why e good to learn hand work especially some wey go service, after school nah wetin remain? White collar job abi? No be for this country, me if I get that opportunity no be to go learn work instead of to go dey carry files dey waka under rain and sun, some people dey lucky while some no dey lucky and peer pressure follow why some no wan learn hand work.
I like as you take address this mata because if we look am, nah true. I just dey tell my guy today say if no be how the government don comot body for ensuring say our youths get gainful employment after school, I no see how them go dey reason to dey do yahoo.
I come dey talk say imagine say our government fit scrap Tertiary education and those finish secondary education go go immediately learn a skill, wetin wan make the economy dey as e dey because now wey e be compulsory something, no body fo get excuse as to why them no get handwork but such a thing no go happen because them (the government) want a situation where them fit dey siphon funds using education as excuse. I dey hear for news when them dey do budget for the year and the amount them dey allocate give education yet we still dey get complaints.