Na for here we dey see say Babambola na work of mockery but for other places, nobody send you as long as you dey make your money and nobody dey put food for table for you.
Yes it is because those guys dey tiff well well. Not a good job. For other places dem nor dey tiff and their systems don make am be say there is good reward for it. The bababomlam dem don tiff people phone, tiff tiff all the manhole wey dey the FCT wey be say, government come dey arrests them.
For here, anybody wey dey do Babambola, them dey see am as poor or wretched person wey dey look for money to take getting wetin to use chop for that day, but now everything don change and even them too dey see money wella from the sales because recycling of waste cans like this don turn big business for Nigeria now.
Recycling dey different.
You fit look for other means take start your bitcoin investment gradually because this method fit make them stigmatize you but if person no send, na to still run am but plenty options dey now to go for.
Whatever path the person chose to use take invest for Bitcoin, make e just be legit. Shikena.