Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Is Bitcoin Only For The Rich?
by
Curious T
on 09/09/2025, 22:35:01 UTC
Hatchy leave this thing, if you no get money you no fit invest in Bitcoin, person never see food chop well e dey go invest in Bitcoin, whether you like am or not if you no get money you no fit invest or buy and hold Bitcoin.

I disagree with you to an extent. I agree, say when you dey poor e dey difficult for you to invest in bitcoin, but at the same time that on e no mean say poor man no fit invest in bitcoin. Bitcoin is the only thing wey be say you fit carry the least 10k to 50k take buy. This one alone dun show say even poor man fit buy am, unlike shares wey one share of profitable company na from N250k and above.

I know bikeman wey use 100k buy btc when e dey around $40k and he dun dey take profit from am dey use that one hold him side from time to time. Na poorman he be, but he dey hold btc.

The rich get the advantage, of course, but Bitcoin na the only thing wey i see say poor man sef fit invest in. Where poor man want to see N1 million+ to get better investment? But with bitcoin, your 50k fit dey give you the least 5k from time to time make you use support yourself.