All this things way you explain say na freedom and say them create Bitcoin both for poor and rich na just sweet mouth if you dey poor you no fit invest in Bitcoin, you no go even think am, because if you think am na hungry go tell you to sell am immediately.
Use hungry play first.
If successful people nor take risk them nor go dey where them dey now. Yes hunger dey but how person one tel comot for hunger if na only to feed and settle bills dey e mind? Dat cycle of poverty go continue until the person say enough is enough and take the risk to invest and bitcoin na one of dis kind of investment wey dey tested and trusted.
We dey forget say nor be to invest like at least $100 before we go know say we invest.