I agree with the other points wey you raise but I no agree with this your number 1 point. People wey de for developing countries get more access to traditional banking system because e de very easy to open bank account. Almost everybody get bank account but na very few people get crypto wallet and people wey get cryptocurrency prefer to spend dem traditional currencies pass cryptocurrency. Furthermore na how many businesses wey you don see wey de accept cryptocurrency
I no fit understand how person wey no get bank account to take convert him crypto to fiat if he want take small profit. Crypto and fiat dey work hand in hand which makes it impossible for anyone wey dey use crypto make no get bank account. Abi no be recently crypto pop up. Banks don dey exist since wey fiat start to dey exist so anybody wey dey in business or get job must get bank account. Infact, some people get bank account and them no get money inside while for tge cryptospace some people get crypto but no get wallet because them use exchange do their wallet.