I need una contribution for dis matta.
Dat Sim Fubara dude just messed himself up by going back there as the emergency rule ended. He has just emasculated himself by dat act. Which mouth wey im go get again as govnor. Nothing at all. No levels. Him go just dey there now as stooge to Wike. It's a pity wetin some people go fit do just to remain relevant in life. He wan continue to dey enjoy convoy ride and d hypocrisy of people wey go dey shout "his excellency" follow am like dog dey follow persin wey get runny stomach.
On Wike's part, it's a pity d godfatherism wey him condemned as govnor na im him com dey do.
Na true you talk so but make we think am, if Fubara no go back as governor who wan go complete him tenure for am? The matter too dey complicated some how and since Wike don get wetin him want nai make Sim come back so, I still see that our governor position as Wike wey dey run am but make e be say na Sim dey dia...the man want to dey call the shots but true true him forget say na so him bin no want make person tell am wetin to do. Man wey like make him words only stands but to listen to other people na problem, Wike be like Octopus, him wan dey control everywhere...I still dey feel for this Sim man because like this him dey on top power but no be him dey give order, the man don tire self
Support PIGIN For Our Local Board...I no fit really blame Sim for going back to office sha, na the president way declare state of emergency for state way emergency no day comes leave states way already dey state of emergency even hin never declare am for there, them too dey like put body for southern issues even when the matter no need their attention, see states way dey under siege from insecurity, them no declare state of emergency for there na Rivers State enter their eye, them don just use this past months pack rivers state money finish and na so e go just dey happen for this country until the citizen actually decide say enough id enough