I greet everyone way dey here, all the noble men and my country people. i no dey active last month due to wetin me and my landlord dey go through, as de man give me quite notice. The matter don way me down and i have less than two months. E dey pain me as i enter this City(Awka) with my woman and my 8 months daughter, thinking i go start a normal family life, but it's unfortunate i go enter for wrong landlord hand, way no want person progress. Right now na house rent i dey look dey gather as the man tends to frustrate me more by removing my electricity, make i dey uncomfortable (others get light, i no get light) I know say everybody get him own matter, but as my own don hook me for neck so tey, i reason to come to here and seek for help ( Luckily i might find my savior here) I reason to use some of my properties as a collateral to lend money from someone way wan help a brother in serious need. My DM is open for anyone that wants me to detail my stories to him/her with proofs to show say me nobi scam but na condition make crayfish bend. I no too get choice now but ready to do what i can to park out from here and get another nice place and settle. Make una weldone.
Admin/Moderator, i dey sorry i have to bring my personal matter come board, abeg make una no remove am..na God i take beg.