Close relationship induced vulnerability

source: Freepik
Abeg, no reason the plenty grammar way I use for that topic header, I go still come down to our local pighin, that one just hard to put for pighin.
The matter I wan talk about like this no be say, na watin plenty of una no know o, in fact cef, if na only una, wahala no for Dey but, make you no con Dey conscious for your end and your close relationship go con sweep ant put for your body.
Watin I Dey talk here be say, make person no go make you fall victim to phishing scam and identity theft scam. Watin make me reason this matter today na due to matter way one of my friend tell me today as we been Dey watch Chelsea match. Omo, as we sit don for one corner with shayo for our front and sharp catfish pepper soup to use clear eye make we for see as Chelsea Dey use tire PSG, na so my friend yarn me matters o. E say one of en younger siblings do make them scam am!
How e carry happen?Na watin I ask am o, e say en sibling reach out to am say, e get game way en friend been introduce am to way them Dey use win money. Say en friend don win #200k for the game and him wan start en own journey for the matter. Say e don pay #4k to access the game and now e need pay another #6k make them for send am codes go use Dey play the game. My friend no really trust the matter but, make e no con be say, na #6k Dey hold en younger siblings progress and make the matter no end for en own side, na so e forward am #6k make en pay.
As e pay the #6k finish, e don contact my friend again say, them say en need another #7.5k to use activate en account well.
Na there my friend para o, e put am for en body say which kind rubbish game be that, say oya make en reach out to en friend way tell am of the game way don collect me for the game, say make e first borrow am #6k or at least, show am detail of the #200k credit transaction and possibly withdraw from the money.
As this younger sibling reach out to the friend, na there the friend tell am say, na scam!
Omo, my friend no fit para but, e just take am say, en sibling suppose learn from this kind matters and most of all, the money no plenty. Them don run am small local, make e see say, the world no pure.
Need to know for this matter be say:
These our siblings them and younger generation, them Dey very hungry for money, to make money Dey the body and na so them go carry fall into small small wahala. We need to Dey watch and caution them well make them no take steps way go cast them.
How this matter take concern us and the safety of our crypto asset?Coming from this part of the world, e no new say, we Dey sabi carry our gadgets give younger siblings or even people we get close relationships with to use do some kind things, maybe play game, watch video, do assignments and entertain themselves in some ways.
Omo, if this na gadget way your wallet Dey inside or you Dey carry work, then you need to draw their ear make them know the kind link way them Dey tap and not to download anything put for your gadget o. Next thing you go know be say, them don download one malware put for your gadget way go steal your privacy details, hack your gadget and collect you wella from your wallet and exchange.
I no say make you preach Bitcoin or cryptocurrency to them o, make you no go endanger yourself, na just to tell them say, make them no do anyhow without your permission for your device, chikina.
If e possible, make you no allow anybody get access to your gadget way contain important tools and files, make it your private space.
Meanwhile, Chelsea wire PSG watin no good, Chelsea fans Oye!