Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
nelson4lov
on 18/07/2020, 12:06:19 UTC
The trick na be say instead of to patronize the ponzi, I buy the coin. Ethereum get future oh make I just highlight am.


This talk make sense. Instead of to join those ponzi schemes, na to buy ETH wey them dey hype, coz I dey sure say thousands of Nigerians wey participate in those schemes buy eth to use join.

E just remind me of when ICOs dey run on ETH, ETH been pump up to $1400 or so just because them dey buy eth to use invest. Nice idea 💡.

Maybe na real-world hustling tins, happy to see u back broda.

Lol. Na true sha. Man dey try improve skillset. Becky thanks Oo.


Becky and Brainboss – now wey both ARPA and DGTX don pump? Which coin we dey look into next? I go like join next train.

Username: Lordhermes
Gender: Male
Country and state of resident: Nigeria/Portharcourt
Developing Skills: Trading.

Before I forget, Lordhermes welcome to the community. I don dey suspect say you be Nigerian since. Me sef dey PH sha 😁