Becky and Brainboss – now wey both ARPA and DGTX don pump... Which coin we dey look into next? I go like join next train.
The market just get potential die but na how to enta before e start to dey rise na where the problem dey, I just the read through twitter jam dis coin
Mainframe although before I fit research am finish, the coin don rise, I read say dey just shift enta DeFi so na wetin burst the price, and since they already dey Binance e make money easy enta. I no buy as the price don fear me but I just dey observe am.
Make una no fear to drop suggestion but try do small research to make people no loss money and always cashout in profit no dey greedy unless you plan to hold that coin for long-term. The project I highlight above me I never buy but just dey observe am, all this DeFi , profit dey am but na for short term oh no go buy dey hold for long as money dey move from one enta another. If you no fit keep up just relax than lose ur money for market. Na trading we dey nobi investing
I take this your observation serious ba add to de plan I don bin get for Ethereum I go buy am now and in time to come I go come back to give testimony
We dey wait, ur greatest challenge go be if you fit get patience because na the key to become a successful Investors. Trading needs smartness, investing needs patience.
@Maestro75 I never see you before, welcome.