Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
CryptopreneurBrainboss
on 20/07/2020, 08:23:29 UTC
Una well done oo! I just the enjoy una discuss na him make I say una Doo!

Na shaking you no get probs but once once make u dey show face make we dey rub head together to achieve greatness for this industry but on and off the forum


Bros, na true you talk because I bin dey go off and on for this forum and na newly I take backlift enter this our thread. But na I wan to dey serious and na im make me wear your agbada for down so that I go begin think say I dey campaign. I try the avatar but the thing too heavy to upload and I no sabi how to resize things. I hail my people.

To resize just Google any resizing site used am, e go work wella. I just reviewed ur profile and you dey try meaning say I dey open to work with you. Just apply for any of my active campaign wey dey accepted full member and u go get am. I appreciate u creating awareness for me doe. tanku.

Becky and Brainboss – now wey both ARPA and DGTX don pump... Which coin we dey look into next? I go like join next train.

The market just get potential die but na how to enta before e start to dey rise na where the problem dey, I just the read through twitter jam dis coin Mainframe although before I fit research am finish, the coin don rise, I read say dey just shift enta DeFi so na wetin burst the price, and since they already dey Binance e make money easy enta. I no buy as the price don fear me but I just dey observe am.

Since I mentioned this project I just notice e do another 50% although me self no buy am. Well I just say me I drop alert say DGTX wey raise from around 5cent to 10cent don dey fall dat's some correction don dey happen so you fit pay attention to the coin see if you fit grab small before nexr bull run happen. Their public launched na 31st of dis month so potential still plenty.